Sweet Mother – Prince Nico Mbarga

 

SONG: Sweet Mother
ARTISTE: Prince Nico Mbarga

LYRICS

[Chorus]
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me ye
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me ye

[Verse]
When I dey cry, my mother go carry me
She go say my pikin wetin you dey cry yo yo
Stop stop, stop stop
Stop stop, make you no cry again oo

When I wan sleep, my mother go pet me
She go lie me well well for bed oh
She cover me cloth, sing make you sleep
Sleep sleep my pikin oh

When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go chop oh
Sweet mother ah, sweet mother eoo

When I dey sick, my mother go cry cry cry
She go say instead when I go die, make she die oh
She go beg God, “God help me,
God help me, my pikin oh”

If I no sleep, my mother no go sleep
If I no chop, my mother no go chop
She no dey tired ah
Sweet mother I no go forget this suffer wey you suffer for me ye ye
Sweet mother ee, sweet mother eey

[Interlude]
Sweet mother I will never forget you
For this suffer you suffer for me
And if I should forget you, therefore I forget my life
The air I breathe
And woo on ye men who forget your mother
For if you forget your mother, you’ve lost your life

[Chorus]
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me ye
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me ye

[Verse]
When I dey cry, my mother go carry me
She go say my pikin wetin you dey cry ye ye
Stop stop, stop stop
Stop stop, make you no cry again

Oh my mother

When I want sleep, my mother go pet me
She go lie me well well for bed oo
She cover me cloth, say make you sleep
Sleep sleep my pikin oh

When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go chop oh
Sweet mother ee, sweet mother eey

When I dey sick, my mother go cry cry cry
She go say instead when I go die, make she die oh
She go beg God, “God help me,
God help me, my pikin oh”

If I no sleep, my mother no go sleep
If I no chop, my mother no go chop
She no dey tire ah, Sweet mother
I no go forget this suffer wey you suffer for me ye ye
Sweet mother ee, sweet mother eey

[Long Outro]
E sweet mother

Ye mother
You are the one who suffer for me
And I always keep that in mind

When I wanted to eat
You cared for me
You gave me what I want

Mum, Susan
My sweet mother
Ay ye ye

My sweet mother
I no go forget you

My sweet mother wey suffer for me
When I dey cry, my mother go cry

She no no wetin she go do
You no well
Na wetin dey worry you my pikin, oh

You fit get another wife
You fit get another husband
But you fit get another
Mother!
No, at all

My mother is great
Greater than the world

When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go chop oh
Sweet mother ah, sweet mother eey

When I dey sick, my mother go cry cry cry
She go say instead when I go die, make she die oh
She go beg God, “God help me,
God help me, my pikin oh”

If I no sleep, my mother no go sleep
If I no chop, my mother no go chop
She no dey tire ah, Sweet mother
I no go forget this suffer wey you suffer for me ye ye
Sweet mother ah, sweet mother eey
Sweet mother ah, sweet mother eey
Sweet mother ah, sweet mother eey


Recommend a Song



    YOU MAY ALSO LIKE

    Advertisement


    BROWSE BY CATEGORY

    Processional

    Recessional

    Reception Entrance

    Couple First Dance

    Father and Daughter

    Mother and Son

    Cake Cutting

    Bouquet Toss

    Garter Removal

    Money Spraying

    Yoruba Wedding

    Igbo Wedding

    Hausa Wedding

    Proposal